- THE DAUGHTERS OF ZELOPHEHAD (2 Kings 22:1–2; 2 Chronicles 34)
Na them gan gan be “no gree for anybody”. As them no wan give them their inheritance because say dey be women, dem fight for am and God dey their back. This their fight change the rules for Israel forever.
- DEBORAH (Judges 4 and 5)
Them suppose dey call her senior woman. the only woman wey be prophet and judge for Israel. At that time, who dey hear say women dey occupy this kind positions, but she do am, and she lead her people to victory for battle.
- QUEEN ESTHER (THE BOOK OF ESTHER)
Na person wey start “if i perish, i perish” be this. She risk her life, use her position to save her people. She show us say God dey put us for big big positions for a purpose, and we gats fulfill that purpose.
- MARY MAGDALENE (JOHN 20:14)
For period wey dem no dey send wetin woman talk, na Mary Magdalene first witness the resurrection of Jesus, and na she be the first official evangelist. She show us say you no need anybody permission if God don give you go ahead.
- PRISCILLA (ACTS 18:24-26)
Along with her husband, she follow dey teach Apollos, correct evangelist for those days. She show us say even women fit sabi Jesus and teach people in the way of the lord.
Which other Sabi Women you know?