We all know say love is a beautiful thing — but no be all of us know say you fit find am inside Instagram DMs. And if you sabi use your head (plus the guidance of the Holy Spirit), that app fit be the place where destiny go cross destiny.
But how you go take do am? No worry, we dae for you. Na because of you gangan we write this article, and you no need go farm like Ruth for bible to meet your own Boaz. You fit meet am too inside Instagram Explore Page.
So here are what you should do to find love on Instagram.
- First and foremost, make sure say you no be wicked human being.
Check yourself well. Make sure say you no be bad person. And if you be bad person, first start to dae do repentance like this or else you go just single forever, because our God no go allow you disturb another person way dae try enter kingdom of God.
- Position yourself wella for IG.
You sef no small now. So open your profile and post fine pictures. Try remove your pastor too from your DP because no be your pastor we go toast, and you suppose don know by now say your pastor no go toast you too. So abeg, komot am, make you put your fine face there.
- Locate your target like a sniper.
Follow them and leave it like that first. No follow them finish, come bombard them with plenty messages o. And no enter their page dae like all their posts like stalker way escape from Yabaleft. Allow them breathe first. Just follow and leave for a while.
- Start your research.
For this one, you gats dae very conscious. First check well if they are spouse material. Check their likes, tags and follow their posts on twitter. Pray well, and open your eyes well to avoid stories that touches the heart.
- Do Strategic Engagement.
Since you follow them but you no fit go straight to their dm, you gats strategise again. Find way to engage them with your Instagram stories, likes and replies. Make sure say you dae watch well sha, make you no go cast.
- Test the waters.
Like this now, you suppose don dae see small small light way resemble green. But no rejoice yet o, just apply small pressure again. You fit start to dae send them memes and reels make you use am check wetin dae sup gangan.
- Make your singleness very clear.
No hide mouth o. Make them know fast fast say you na only Jesus be your babe, and room dae for one more. No go let your odogwu or odogwuress pass you by.
- Jam them outside!
“Ahn ahn, you too you came?” Na so you go take talk am when you jam them for that next event. No worry, them no go know say na you be the monitoring spirit way dae follow them back to back. Them go think say na coincidence.
- Officially shoot your shot.
After all said and done, no let all your hardwork just go like that. Find way tell them say you dae eye them, and ask if them fit be the flesh of your bone. If you do am well, you suppose invite us come your wedding by like July 2026. But if otherwise and e no work, well use am do character development.
See you when we get new set of advice for you.