HOW TO SHOOT YOUR SHOT AS A LADY – BY OYIN OLUDAPO

Dear woman, make I yarn you one little secret — to shoot your shot as babe no mean say you go dey chase man anyhow. At all! Na positioning dey do the real work. E dey about how you carry yourself, how you show up, and how you sabi give green light without shouting from two storey building.

 

No be say you go turn to hunter.

You just gats be wise. Soft. Sharp. And Strategic.

 

Now if you wan know how you go shoot your shot without looking desperate or forward — then carry chair sit down, cos this article na your plug.

 

Here are 4 steps way you fit use shoot that shot like say you be Lionel Messi younger sister.

 

  • Put yourself where the person dey.

 

This one be like say e simple, but e dae very underrated. The trick na to make sure say the man dae “coincidentally” see you everywhere. If you know the kain events or programs way he dae go, you sef dust your bible, dress fine and attend the program. Do am for like two to three events and you go see say una go later jam talk one or two.

 

  • Engage for their social media.

 

As them dae shine teeth for Zuckerberg internet, you sef drop comment and likes for them make their head swell up like garri ijebu. Reply their story, like their posts and drop correct comments on things way them like to talk about too. Before you say “Tinubu”, them go don slide inside your dm to say hi.

 

  • Bond on things way una get in common.

 

If you see say the man like to dae watch movies, and you sef na movie person, use that one too enter them. If na music, you fit recommend our “New On the Block”

playlists for them. Even if na programs way you know say them go enjoy, you fit bring am to their attention, make una start to dae bond from there.

 

 

  • Drop compliments way go burst their brain,


Men dey form hard guy but lowkey, dem dey love praise pass birthday shoutout. So if you fit dae drop correct compliments way go burst their brain, you don already fence 2 plots inside him heart.

 

No dey do “I can’t text first” babe. Hype that man small. Run am smooth.

Make he feel good around you, and before you know, e go dey find excuse to dey where you dey.

 

 

Extra Bonus for you.

 

Before you try shoot that shot, make sure say you no be bad person and people no dae run from you. Also make sure say you sabi start and hold conversations well well. Na inside small conversations, deep ones dae come out.

Lastly, you need know say if the person no later reason you, e no mean anything for you. Na just how e be, so just move on.

 

No talk say we for StreetChurch no do anything for you o. You are welcome.

Share Article:

Picture of Derin Adenihun

Derin Adenihun

You might also like

  Naija Christian space no gree dull last week o. If you blink small, you fit miss the movement wey God dey do through music,

View on Instagram This week on #SCSpotted, we are highlighting some of our fave looks, picked at the Street Church HQ. Tolu Odukoya stuns in

Tomiwa and Mary’s love story is proof that when God writes it, time no fit scatter am. From a random glance at a camp meeting

From church to office to high-end events and engagements, these people na proof say drip plenty to go round. Style icons wey you fit follow

Follow our socials

New on The Block

Subscribe to the Street Church Newsletters

Stay up to date with our weekly newsletters and never miss any of the action.