STYLE ICONS WEY YOU FIT FOLLOW TO IMPROVE YOUR STEEZE

From church to office to high-end events and engagements, these people na proof say drip plenty to go round. Style icons wey you fit follow to improve your steeze and drip.

 

  • IFEOMA NWOBU (@ifbnw)

 

Entrepreneur and Lifestyle Influencer, Ifeoma Nwobu dey in her own class. Na she gangan be the person wey we no fit tie her shoes!

 

  • BUNMI GEORGE (@jbums)

Jesus Bums! She no be ordinary influencer o, na she be the influence! This one na aura wey get fire, the steeze no dey ever stop, chai!

 

  • MOSES BLISS (@mosesbliss)

 

No be only heavenly sounds Moses Bliss dey give us o, heavenly drip sef dey. Oya check am, e tap abi e no tap?

 

  • DEBOLA DEJI-KURUNMI (@deboladejikurunmi)

 

DDK dey always give us maximum steeze and composure. Power woman wey no dey play with her drip, na wetin we like be that!

 

  • ADA EHI (@adaehimoses)

 

Bold, colourful, with plenty energy, Ada Ehi no dey ever miss! Every outing, music video, ministration na power and fashion moment, she too sabi!

 

  • SHOLA OKODUGHA (@okodughaolushola)

 

Pastor Shola dey always give aura for aura, senior man vibes. From aso-oke, to cotton, to ankara, nothing wey Pastor Shola no fit slay abeg!

 

  • TEMILADE SALAMI (@theglobaltemi)

 

Others dey always run from colours but e be like say na Temi invent am o. If you wan see colour matching wey you never see before, go Temi page, no matter the colour, e go bang for her body!

 

  • VEEKEE JAMES (@veekee_james)

 

The question we actually suppose dey ask nah wetin Veekee James no fit do? As she dey design fire outfits for her clients, her own still dey always bang. Abeg make una help us ask her, what did you add in your stew?

 

  • EMMANUEL IREN (@pst_iren)

 

Pastey dey always give apostolic purrr! Apostle Iren dey give fire for pulpit and also for hin drips. For where he dey, we still dey learn work mehn!

 

  • JUMOKE SHOTONWA (@jumoke_shotonwa)

 

International fashion stylist Jumoke Shotonwa na the person you suppose go meet if you wan up your steeze, she dey style fire! Her own styling no dey ordinary please, e too hot!

 

  • TUNDE TNT (@tunde_tnt)

 

Mr Doings wey too sabi! Tunde TNT steeze na special kind, no angle e no dey come from! If you be man wey wan serious with your fashion, follow him sharp sharp. Women, send hin page to your boo abeg!

Who be your fave? And which other person suppose dey here?

Share Article:

Picture of Derin Adenihun

Derin Adenihun

You might also like

  Naija Christian space no gree dull last week o. If you blink small, you fit miss the movement wey God dey do through music,

View on Instagram This week on #SCSpotted, we are highlighting some of our fave looks, picked at the Street Church HQ. Tolu Odukoya stuns in

Tomiwa and Mary’s love story is proof that when God writes it, time no fit scatter am. From a random glance at a camp meeting

  Hi Tolu, how are you today? Mehn, I’m good good, life’s good, God is good. So how did you meet Charles? Charles and I

Follow our socials

New on The Block

Subscribe to the Street Church Newsletters

Stay up to date with our weekly newsletters and never miss any of the action.